23 Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!
True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.
Wise word get gain and hard work dey bring reward.
If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.
Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.
bikos, honest ansa na good sign for true friendship.
Evritin wey dey happen for dis world, dey happen for di rite time wey God wont make e happen.
God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
Wen John two disciples hear wetin e tok, dem kon follow Jesus.
Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go meet Jesus.
Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.