21 Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do, but pipol wey get sense, dey happy to get wisdom.
E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout.
Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.
Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
Foolish pipol dey laf dia own foolishness, but doz wey dey fear God, dey know and ask for forgivenes.
Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
Make yu look strait and nor bow yor head, bikos yu dey shame.
Anytin wey yu won do, make yu plan am well, den evritin wey yu do go dey okay.
Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.
Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.