20 Shidren wey get sense dey always bring joy to dia papa; but foolish shidren nor dey respet dia mama.
kon pray sey, ‘Make wi praiz di Oga wey bi Israel pipol God, wey don make one of my pikin take my place as king and E make mi dey alive to si am!’ ”
But naw, nor si am as innocent pesin. Yu bi man wey get wisdom, yu know wetin yu go do am. Make sure sey dem kill-am.”
Hiram happy wen dem gi-am Solomon message so e kon sey, “Make wi praiz God today wey give David dat kind pikin as king ova dis strong nashon!”
Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.
Listin to yor papa; bikos without am, yu nor go dey dis world and wen yor mama don old, make yu still dey respet am.
Good pesin papa get betta rizin to happy and e go dey happy if en pikin get wisdom.
If yu value wisdom, yor papa go dey proud of yu, but na foolish tin to spend money for ashawo.
“Di mout wey dey laf en papa and nor dey obey en mama kommand, bird from valley go plok am komot and vulture go chop am finish.
Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.
Una know how mi and Timoti bi, sey as pikin dey work with en papa, na so e dey follow mi work, so dat di gospel go stand.