16 E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.
So e dey good to fear God with di small money wey pesin get, dan to do evil kon get money well-well.
Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.
Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol; but pipol wey dey happy, dey always celebrate.
E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
E betta to chop dry bread with peace of mind, dan to get plenty food for house with kworel.
E betta to dey poor and honest, dan to dey rish and dey do wayo.
E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward.