Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.
E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”
Na breeze Efraim pipol dey chop. Dem dey porshu breeze from morning go rish nite. Dem dey gada lie and wahala kon enter agriment with Assyria and dey do business with Egypt pipol.
Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true.
But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.