9 Foolish pipol dey laf dia own foolishness, but doz wey dey fear God, dey know and ask for forgivenes.
how E won take bilive man wey dey drink bad and wiked tins like wota?
Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
Foolish pipol dey enjoy di bad tins wey dem dey do, but pipol wey get sense, dey happy to get wisdom.
God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.
God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
Dem dey respet pesin wey get sense, but sturbon pipol go distroy demsef.
God nor get wetin E won do with proud pipol, but E dey favor pipol wey dey honbol.
If yu do like dat, both God and human being go dey happy and favor yu.
“Ashawo woman wey sleep with anoda man fit kill pesin, afta e go klean en mout kon sey, ‘Na wish bad tin I do?’
Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.
“ ‘But if di pesin nor fit bring sheep or goat, e go bring two dove or two pijin as ofrin for di sin wey e kommit. One go bi for di sin ofrin and di oda one go bi burnt ofrin.
Dem sey, “For di time wen dis world won end, some pipol go dey laf una and di tins wey God hate wey dey hongry dem to do, naim go dey push dem.”