8 Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.
Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
If to sey I fit live my life just as Yu tok
Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.
Evry morning, make I dey hear about yor love wey nor dey fail, bikos I trust Yu. Make Yu show mi where to go, bikos I don give mysef to Yu.
Wiked pipol nor get gain for anytin, but reward dey for who dey do di korrect tin.
Good pipol dey always tink good, but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
Foolishness dey make doz wey nor get sense happy; but pesin wey get sense, dey always do di rite tin.
So, if yu listin to wetin I dey tok; yu go know wetin dey rite, true and korrect, den kon know wetin yu suppose do.
I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,
I don si sey, just as lite betta pass darkness, na so too, to know sometin, betta pass foolishness.
Bikos both wise and foolish man, go die and time dey kom wen dem nor go remember di wise pesin just as dem nor go remember di foolish pesin again! So one day, pipol go forget di two of dem.
Jerusalem pipol, make una si, una enemies dey pass nort dey kom! Where di pipol wey dey kare for una, di pipol wey make una dey proud?
Dis world wisdom, na foolishness for God present. Bikos God word sey, “God dey ponish pipol wey tink sey dem wise.”
Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins
Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean.
But wiked and evil pipol nor go prosper. Dem go deceive odas and dem go deceive diasef too.
Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.