Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 14:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Pipol wey karry body up dey find wisdom, but dem nor go si am, but undastandin dey eazy for pesin wey get sense.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 14:6
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make Yu open my eyes to si di wonderful tins wey dey yor law.


Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,


Good witness nor dey lie, but na lie-lie, wiked pipol dey tok.


Make yu waka leave foolish pesin, if not, yu nor go undastand wen wise pesin dey tok to yu.


Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon, so dem dey run from wise pipol.


Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi.


Pesin wey get sense dey tink and do good tins one-by-one, but foolish pipol dey start many tins at wons.


Foolish pesin nor dey worry weda e undastand sometin or not; di only tin wey dey en mind, na to show how e wise rish.


Wise word too deep for foolish pipol to undastand. So wen ever pipol dey tok about sirious matter, foolish pipol nor get any betta tin to tok put.


Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.


Evritin wey I tok na true; I nor dey lie or dey lead una go die.


My words dey klear and evribody wey get wisdom, go undastand dem.


Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.


Shame go katch una wise men, dem go konfuse and God go judge dem, bikos dem don rijet wetin E tok. Na wish kind sense dem tink sey dem get sef?


Di man wey tink sey e know sometin, neva still know as e suppose know.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ