4 If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.
Yu sure sey e go gri use en pawa take do yor heavy work?
Make awa melu karry many propaty as dem dey kom. Make no enemy break enter awa wall kon katch us and make peace dey awa town.
Poor pesin farm fit produce many food, but wikedness dey make dem disappear.
Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
Good witness nor dey lie, but na lie-lie, wiked pipol dey tok.
God sey, “Na mi make hongry dey una town, but una nor still gri turn kom meet mi.