33 Wisdom dey follow pesin wey dey fear God; but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
Wise pipol dey tink before dem do anytin, but foolish pipol nor dey tink and dem dey happy sey dem foolish.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
Wen pipol dey fear God, dia nashon go dey great, but sin na disgrace to evribody.
Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.
Doz wey dey fear God, dey tink before dem tok; but na only evil words full wiked pipol mout.
Yu go dey wise and di sense wey yu get go give yu happiness.
Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef.
and even wen foolish pesin dey waka for road, e dey know and show evribody sey e bi fool!