Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 14:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 14:31
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.


So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”


Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.


If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.


Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.


If yu dey give rish pipol gift kon dey opress poor pipol make yu for get more money, yu go poor too.


Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.


If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.


Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.


Make una nor play una fellow Israel pesin wayo, but make una obey di Oga una God.


“ ‘If una fellow Israel pesin dey poor and e nor fit support ensef, una must gi-am evritin as una dey give di pipol wey una hire, so dat dem go kontinue to stay with una.


Poor pipol go always dey with una, but I nor go dey with una all di time.”


Make una nor opress poor pipol and doz wey dey work for una; weda dem bi Israel pipol or strenjas wey dey stay with una.


God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ