3 Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
God go diliver yu from trobol; E go save yu wen distroshon kom.
Make God kut di tongue wey dey tok anyhow kon distroy di mout wey dey boast!
Make Yu klose dia lie-lie mout forever; doz pipol wey get bad mout and dey akuiz God pipol.
Na lions gada round mi so! I dey with pipol wey won kill mi; pipol wey dia tit sharp like spear and arrow and wey dia words dey kut like swods.
Wiked pipol word dey kill, but raitious pipol word dey save pipol.
Doz wey dey kontrol dia tongue go get long life, bikos anyhow word dey distroy tins.
If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.
Wen foolish pesin start to argue, na trobol e dey put ensef.
Foolish pesin word dey distroy am; na en own mout dey put am for trobol.
Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
I still won know about di ten horns for en head; di horns wey grow kom out leta; di three horns wey fall wey get eye and mout wey dey tok anyhow and en face dey make pesin fear pass any of di oda beast dem own.
Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins.
God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.
Bikos yu don obey my kommandment wey bi to get patient, I go protet yu wen I won test evribody for dis world.
Make una stop to tok anyhow; make betta word dey kom out from una mout, bikos di Oga God na God wey know evritin wey pipol dey do.