Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 14:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 14:21
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.


Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.


Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa. E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.


E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


If yu dey laf poor pipol, den yu dey curse God wey kreate dem, so pesin wey dey happy sey odas fall, God go ponish am.


Na sin and shame dey waka togeda. Wen yu luz yor honor, pipol nor go respet yu again.


Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.


Wiked pipol dey always like to do wiked tins, so dem nor dey pity for anybody.


Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu.


Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack, but if yu nor dey sorry for poor pipol, dem go curse yu.


If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.


So, my king! Make yu follow my advise. Make yu turn from sin kom meet God; dey do good and sorry for poor pipol. Den yu go kontinue to prosper.”


Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem.


Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”


Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.


So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ