11 Dem go distroy wiked pipol house, but doz wey dey fear God, go prosper.
Doz wey nor dey fear God nor go get anytin at-all and na fire go burn di house wey dem build with wayo money.
‘True-true, na so wiked pipol house dey bi and pipol wey nor know God, na dem dey stay dis kind place.’ ”
Yu go soon tell mi about rish and wiked pipol wey dia house don vanish bikos of sin.
If dem rest for spider house, e go fit hold dem? If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”
if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.
Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree.
Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.
Wiked pipol dey die trowey, but doz wey dey fear God, dey get long life.
God dey skata proud pipol house, but wimen wey dia husband don die, God dey protet dia propaty.
God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.
Wise pesin fit get plenty money and dey enjoy ensef, but as soon as foolish pipol get dia money, dem go spend am anyhow.
God don curse wiked pipol house, while blessings full raitious pipol own.
Oga God sey, “Doz wey dey tif and lie, I go send dis curse go meet dem for dia house and di curse go stay and distroy dem finish.”