Dem kon tell each oda, “Dem dey ponish us, bikos of awa broda Josef, bikos wi si en pain wen e dey kry make wi sorry for am, but wi nor gri listin to am. Na-im make all dis tins dey happen to us so!”
Wen di woman waka meet di profet on-top di mountin, e kon fall hold am for leg. Gehazi won kon porshu am komot, but di profet sey, “Leave am, dis woman dey pass thru pain and God nor let mi know before naw.”
Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”
But Hannah ansa, “My oga! Nor bi as yu tink am! My mind nor setol at-all. I nor drink as yu dey tink o-o. I just dey tell God evritin wey dey my heart.