1 Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
E nor only kommit sin like Jeroboam, but e go marry Jezebel wey bi King Etbaal for Sidon, pikin and Ahab still dey woship Baal.
Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family.
Foolish shidren fit distroy dia papa and mama, na so too, wife wey dey komplain well-well, bi like rain wey dey drop small-small.
E betta to stay desert dan to stay house with wife wey dey komplain well-well.
E betta make yu stay on-top house dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.