Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 13:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Poor pipol dey bihave like sey dem get money, but doz wey get money dey pritend sey dem poor.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 13:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.


E betta make yu bi ordinary pesin wey dey work to chop, dan to dey karry body up wen yu nor even get garri to soak.


Money wey pesin play wayo take get kwik-kwik, dey disappear, but di one from hard work dey last forever.


Rish pipol fit pay anytin for dia life, but nobody dey treaten poor man.


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


“Na so e go bi with pesin wey dey gada money keep for ensef, but en heart nor dey with God.”


Make una sell evritin wey una get and give di money to poor pipol. Bag wey nor go tear, make una take am gada betta tins for heaven, where tif nor go fit rish and siti-siti nor go fit spoil dem.


Una don really get evritin wey una nid! Una don get plenty money! Una don turn king with us! How I wish sey una really bi king, so dat wi go dey rule with una.


But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa.


wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.


I know di sofa wey yu sofa and how yu nor get money, but yu get enough money. I still know di bad tins wey dem tok about yu. Dem sey dem bi Jew pipol, but dem nor bi Jew, bikos dia sinagog, na Satan own.


Bikos yu dey sey, “I get plenty money and I nor nid anytin!” But yu nor know sey yor kondishon bad well-well, yu dey sofa; yu poor; blind and naked.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ