6 Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.
Solomon ansa, “If e go respet mi, I nor go even tosh one hair for en head, but if e nor respet mi, I go kill-am.”
Dis sin wey e kommit kon make en kingdom skata rish groun.
E sakrifice give Damaskus juju, bikos e tink sey na di juju win am. E tok for en mind sey, “Bikos Damaskus juju help en pipol, I go sakrifice gi-am, so dat e go kom help mi too.” But dis won kon make Assyria sojas distroy en and evribody for Judah.
Make una si as God dey bless pipol wey dey do wetin dey rite and obey en kommand.
Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.
Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite; pipol wey dey tok trut with pure heart.
As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.
God dey protet pipol wey dey tok trut, but doz wey dey do bad tins, na distroshon bi dia own.
God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.
Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.