Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 13:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Doz wey dey fear God, go get enough food to chop, but na honga go kill wiked pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 13:25
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own.


I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land.


Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.


So e dey good to fear God with di small money wey pesin get, dan to do evil kon get money well-well.


Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.


God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont.


If yu vex sey pipol dey korrect yu, na poverty and disgrace go end yor life; but dem go honor yu, if yu asept korreshon.


but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.


But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.


Wen e don finish all wetin e get, e nor si anytin to chop, bikos honga dey for dat kountry, so e kon dey sofa.


una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.


Honga go kill dem, betta sofa go worry dem. I go send wiked animal and bad snakes go chop dem.


bikos even wen wi dey with una, wi tell una sey, “Pesin wey nor ready to work, make e nor chop.”


Fisical trainin dey good, but na to know God good pass, bikos yu go get reward for dis life and di one wey dey kom.


Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ