24 Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn; if yu nor do like dat, yu dey help dem distroy dia life.
Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.
To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.
Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all.
Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.
But doz wey nor find mi, dey wound demsef and anybody wey hate mi, love to die.”
“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.
Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.