Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 13:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Good pipol dey leave propaty for dia grand-shidren, but na doz wey dey fear God dey take evritin wey wiked pipol die leave.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 13:22
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem tell us sey if wi won stay der for peace and leave am for awa shidren-shidren forever, make wi nor marry doz pipol or help dem prosper.


Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”


En shidren-shidren go get pawa for dis world and God go bless di pipol wey dey obey am.


Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land!


Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old, I neva si God leave doz wey dey fear am or allow dia shidren go beg for food.


Papa and mama dey-dey proud of dia grand-shidren, bikos na shidren bi dia papa and mama crown.


If yu get money from intrest wey yu dey kollect, bikos di pipol kon borrow from yu, one day, one pesin go kom kollect all yor propaty and e go sorry for poor pipol.


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ