Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 13:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem, but na blessing, raitious pipol go gain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 13:21
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Nor bi true sey if yu do wetin dey write, body go sweet yu? But if yu nor do wetin dey write, dat mean sey sin dey knock for yor door, bikos e won rule yu, but make yu nor allow am.”


Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.


Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.


Make evry wiked plan wey my enemies dey plan, turn back go meet dem.


Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.


Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.


If yu use bad take pay good, den bad tin nor go ever komot from yor house.


bikos no matter how many times good pipol fall; dem dey always get up again; but trobol dey distroy wiked pipol.


So, wahala go kom meet yu and yor majik nor go fit help yu. Wahala wey yu nor espect, go happen to yu at wons! Even trobol wey yu nor tink of, go rush kom meet yu like wota.


Dis na wetin God wey get pawa tok: “Israel pipol, I go ponish una well-well.


“But if una nor do wetin una promise, I dey warn una, bikos na sin una don kommit against God bi dat. Make una nor konfuse unasef; bikos una go must get di ponishment for una sin.


Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ