14 Wise pipol word bi like wota wey dey give life and doz wey asept am, dey run from deat.
bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si.
na so-so grave I dey dream about and na to die, dey hongry mi.
Good pesin word dey give long life, but wiked pesin word dey put am for trobol.
To fear God, na wota wey dey give pesin life and e go help yu run from deat.
Wise pipol dey waka for di road wey dey lead to life and nor bi di one wey go take dem go grave.
Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
If pesin dey honbol and faithful, God go forgi-am en sins. If yu dey fear God, yu nor go gri do bad tins.
Wisdom go add more years to yor age.
God bless yu as yu take judge di kase! Make God reward yu, bikos yu nor let mi kill pipol kon do as my own mind dey tell mi.