Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand.
Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.
Azaraya wey bi Hoshaaya pikin and Johanan wey Kareah born with di oda sturbon men for Jerusalem kon tell mi, “Na lie yu dey lie! Di Oga awa God nor sey make yu tell us make wi nor go Egypt.
“But even as dem dey wildaness, dem rijet mi. Dem break my laws kon rijet my kommand wey dey give life to doz wey dey obey am. Dem distroy di Sabat finish. Wen dem dey di wildaness, I dey ready to make dem feel as my vexnashon strong rish.
Den di pipol wey dey fear God kon tok to each oda and God listin and hear wetin dem tok. For God present, all doz wey dey fear and respet en name, dem kon rite dia name put for one book so dat God go remember dem.
make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”