Wen di pipol si sey di king nor won listin to dem, dem kon bigin shaut, “Make David and en family get out! Wetin dem don do for us before? Israel pipol; make wi dey go house! Make King Rehoboam kare for ensef!” So Israel pipol kon bigin kworel among demsef
Yu distroy Edom pipol and e don dey make yor head big! Yu dey happy bikos yu win, but make yu stay for yor palis. Wetin make yu dey kause wahala for yorsef? Wetin make yu won distroy yorsef and Judah?”
Evribody wey si am kon sey, “Wi neva hear dis kind tin before! Dis kind tin neva happen wons since Israel pipol komot from Egypt! Wi nid to do sometin about am! So dem kon dey tok among demsef dey ask, ‘Na wetin wi go do naw?’ ”