God don konfuse dem; dem dey give wrong advise and evritin wey Egypt pipol dey do, nor dey rite at-all and naw, di pipol dey stagga like drunkard man wey sleep on-top en vomit.
“Di oga praiz di wayo manaja, bikos of di wayo sense wey e use. Bikos dis world pipol sabi use dia wayo sense for business pass pipol wey dey for lite.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
Den Samuel tell Saul, “Na foolish tin yu don do so o-o! Yu nor obey di kommandment wey di Oga yor God give yu. If to sey yu obey, God for make yu king for Israel forever.
One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”
“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!
Naw, wi wont make yu know, so dat yu go fit do sometin about am. Bikos betta wahala dey kom for awa oga and en family. E too wiked and nobody fit tell am anytin!”