7 Wiked pipol dey die trowey, but doz wey dey fear God, dey get long life.
En house and kingdom go dey before mi forever; en family go rule forever.’ ”
Dem go know yor name and pipol go tok forever sey, ‘God Almighty na Israel pipol God’ and Yu go always dey protet my kingdom.
Di king kon orda sey make dem do am and dem read di law for Shushan, den dem hang Haman sons body.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
Bikos E know wetin di leader do. E fit ova-trow and skata dem for nite.
Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem, una nor go si dem again.
Wen heavy breeze dey blow, e go blow wiked pipol trowey, but pipol wey dey tok trut, dey always dey save.
Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.
Dem dey praiz pesin wey get sense, but nobody dey respet wiked pesin.
Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.
Dem go distroy wiked pipol house, but doz wey dey fear God, go prosper.
God dey skata proud pipol house, but wimen wey dia husband don die, God dey protet dia propaty.