6 Wiked pipol word dey kill, but raitious pipol word dey save pipol.
Good pipol dey always tink good, but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.
Foolish words go make dem flog pesin, but wise pesin words, go save en life.
Na only evil tins una dey plan to do. Una nor dey fear to kill innocent pipol. Anywhere wey una dey go, na only wahala una dey kause for der
Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.
Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.
So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”
Dem beg am make e give orda sey make dem bring Paul kom Jerusalem back, bikos dem plan to attack and kill-am for road.