God still sey make I tell di pipol, “Make una listin! Mi wey bi God, dey give una shance to choose between dis two tins: ‘Di way wey dey lead to life or di one wey dey lead to deat.’
and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.
“I koll heaven and eart make dem bi witness against una today sey, I don give una choice between life and deat, blessing and curse. So make una choose life, so dat una with una shidren go get long life.
So my shidren, make una nor let anybody deceive una: If pesin dey do wetin good for God eye, dat show sey dat pesin dey good, just as Christ dey good for God eye.