27 Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch, but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
So e dey good to fear God with di small money wey pesin get, dan to do evil kon get money well-well.
Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
E betta to get small propaty and still dey fear God, dan to get evritin with many-many wahala.
E betta to dey honest even doh yu nor get plenty money, dan to use wayo get plenty propaty.
If yu dey too chop and nor dey beleful, make yu respet yorsef.
Lazy pesin go just dey turn up-and-down for bed like door handle and
some pipol too lazy to even put food for dia own mout.