26 Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.
Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.
Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.
If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.
Lazy pipol nor even fit kook di animal wey dem katch, but doz wey get sense, dey use evritin wey dem get, well.
If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.
Pipol wey dey kause wahala dey deceive dia friends enter trobol.
Doz wey dey sure of demsef nor dey tok anyhow and kwayet pipol dey undastand tins well.
Na dis tins I dey rite give una about pipol wey dey try to deceive una.
Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.
E deceive di pipol for dis eart with di mirakles wey e dey do for di beast front and e tell di pipol sey, make dem make one image for di beast (wey wound before, but still dey alive).