Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 12:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 If pesin dey worry, e go make am sick, but betta word go make yor body strong again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 12:25
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I nor fit stand strait again and wahala full my life. Evriday, I dey kry and mourn waka.


Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!


Foolish pipol dey tok anyhow, but wetin wise pipol tok, dey heal many wound.


Doz wey dey fear God dey advise dia friends well, but wiked pipol dey lead dem enter wahala.


As yu dey happy wen good tin happen to yu, na so too e go bi wen pain kom. Nobody go fit share dem with yu.


Pipol dey smile wen dem dey happy, but sorrow dey make dia spirit weak.


Pipol wey get heavy heart, get plenty trobol; but pipol wey dey happy, dey always celebrate.


Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!


Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.


Good words bi like honey; e dey sweet di soul kon make body strong.


Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small.


Di mind to live fit enkourage pesin wen e dey sick, but if e nor get strong mind, e nor get hope bi dat.


Bikos betta words wey dem tok well, bi like gold wey dem take dekorate silva.


Just as perfume and fine oil dey make pesin happy, na so too betta advise from pesin friend, dey bring joy to en heart.


God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.


So God ansa di angel wey dey tok to mi with words wey dey make belle sweet pesin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ