Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 12:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 12:22
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di old profet lie gi-am kon sey, “Mi too na profet like yu and God kommand mi thru en angel sey make I kare for yu for my house.”


My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.


Yu go distroy doz wey dey lie well-well. God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.


God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.


God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


Since betta words nor fit kom out from fool mout, how e go bi for leaders wey dey lie.


Na di old pipol and rulers, bi di head, while di tail, na di profet wey dey lie waka.


If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin. Mi, wey bi God, don tok.”


Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”


Una dey use una lie take diskorage good pipol; pipol wey I nor like to ponish. Una nor let evil pipol shange from di bad tins wey dem dey do, so dat dem go dey save.


But for pipol wey fear nor dey let dem do wetin good; doz wey nor bilive mi, doz wey nor dey obey mi; doz wey kill odas; pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey do majik; pipol wey dey serve juju and evribody wey dey tok lie, na inside di fire and sulfur dem go-go. And na dat bi di sekond deat.”


Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ