21 Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God, but na trobol dey always follow wiked pipol.
God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.
no evil go fit tosh una and no wahala or diziz go kom near where una dey.
So, una go get wetin fit una and wetin una do, go make una sick.
But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.
Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.
Pesin wey dey tink so-so bad-bad tins, na wikedness full en heart, but doz wey like peace, get joy for dia life.
Just as doz wey dey judge odas dey get wetin dem deserve; na so too good pipol dey get dia reward.
Obey God and yu go get long life; yu go dey happy and dey save from trobol.
But make yu listin to all dis warnin, bikos anybody wey dey fear God, go dey save.
Di king nor go ponish pesin wey dey obey am and doz wey dey wise, go find di way and time to do wetin dey good.
Instead make dem honor una, na disgrace go follow una and na una by unasef go drink kon stagga fall. God go make una drink from una own ponishment cup and una honor go turn to disgrace.
And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.
Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world.
Who go fit do yu bad tin, if yu dey do good?
Make yu pay am as e take pay odas; pay am doubol for wetin e do. For di wine cup wey e mix, make yu mix doubol for am.