16 Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.
Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.
Good witness dey tok trut, but wiked pipol dey always lie.
Wisdom dey follow pesin wey dey fear God; but yu nor fit si wisdom for where foolish pipol dey.
Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad. Remember sey bad tin fit skata friendship.
If yu dey vex anyhow and nor fit kontrol yorsef, yu bi like town wey nor get fence at-all and wey dey eazy for enemy to attack.
Even doh san and stone dey heavy, e nor still heavy rish di wahala wey foolish pesin dey kause.
Stupid pipol dey show dia vexnashon for publik, but pipol wey get sense, dey-dey patient and kontrol demsef.
My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.