Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 12:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Wiked pipol words dey put dem for wahala, but raitious pipol go eskape from trobol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 12:13
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”


David kon ansa dem, “As long as di God wey save mi from all danger dey alive,


Den Solomon swear with God name sey, “Make God ponish mi if I nor make Adonijah pay with en life for dis tin wey e ask for!


Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well, but God go save dem from all dia wahala.


God dey protet en pipol well-well and E nor go let any bad tin happen to dem,


Yu go distroy doz wey dey lie well-well. God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.


Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips, make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.


Make Yu distroy dem as Yu dey vex! Make Yu distroy dem finish! Den di whole world go know sey God dey reign for Israel.


Na dia own bad word go kill dem. And anybody wey si dem, go shake en head kon sorry for dem.


Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem.


Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol.


Wen wise pipol tok, pipol dey undastand well, but na only yeye words dey kom out from foolish pipol mout.


Wetin yu tok fit save or distroy yor life. So yu must asept di result of wetin yu tok.


If yu nor won enter trobol, make yu tink before yu tok.


and dem kon owe yu for di promise wey yu make,


But make yu listin to all dis warnin, bikos anybody wey dey fear God, go dey save.


Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.


Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”


If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ