Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 12:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif, but wetin raitious pipol get, dey rish dem, bikos dem dey work for dia own food.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 12:12
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.


Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.


Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.


Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol.


Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.


Wiked pipol dey always like to do wiked tins, so dem nor dey pity for anybody.


Time dey kom wen Jakob shidren-shidren go get rut like tree and dem go grow well. Di fruit wey dem go bear, go full di eart.


Doz wey go survive for Judah, go grow like plant wey en rut deep well-well kon produce betta fruit.


Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.


Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.


“Na mi bi di vine and na una bi di branches dem. Di pesin wey stay inside mi and I stay inside am, go bear plenty fruit, bikos without mi, una nor go fit do anytin.


But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ