Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 12:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 12:11
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”


Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure.


I nor get time to spend with lie-lie pipol or waka with dem.


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


Poor pesin farm fit produce many food, but wikedness dey make dem disappear.


Good work dey bring gain, but yeye word dey kause poverty!


If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.


If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.


and yu go get plenty goat milk to take feed yu, yor family and yor wimen savant.


Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem.


But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.


and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well.


Foolishness bi like woman wey nor know anytin at-all, nor get shame at-all and wey dey tok anyhow.


“Pipol wey nor get sense, make una kom inside!” Den e go tell foolish pipol,


Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.”


Doz wey dey woship juju, don abandon di good tins wey God suppose do for dem.


Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.


Wi nor chop anybody food wey wi nor pay for. Instead, wi dey struggol and work hard for day and nite, so dat wi nor go bi wahala to una.


Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ