1 Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.
Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.
So, make yu nor bi like horse or animal wey nor get sense and wey nid kane to kontrol am.”
Una nor gri listin to my kommand, instead una dey do my word anyhow like dirty.
Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey:
Pipol wey get sense dey happy well-well wen dem advise dem, but foolish pipol words go distroy dem.
Doz wey good, dey get dia reward for dis world, but na ponishment go follow pipol wey dey sin and do wiked tins.
God dey happy with good pipol, but E dey kondemn doz wey dey plan wiked tins.
Anybody wey nor gri do wetin dey rite, go sofa well-well and anybody wey nor like korreshon, go die.
Pipol wey nor kare about odas, dey tink only about demsef; so dem nor go gri take korreshon from oda pipol.
“I dey foolish pass any oda man and I nor get sense like oda pipol.
I love only doz wey love mi; anybody wey dey look for mi, go si mi.
So, make yong pipol listin to mi naw kon do wetin I tok and dem go dey happy.
But doz wey nor find mi, dey wound demsef and anybody wey hate mi, love to die.”
Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”
e go look am. If white sore dey di skin wey turn di hair to white and e get plenty pus,
E go use wayo deceive doz wey go perish, bikos dem nor won love and respet di trut wey for save dem.