7 Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.
Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.
God dey protet pipol wey dey tok trut, but doz wey dey do bad tins, na distroshon bi dia own.
Pipol wey dey raitious, God dey protet dem from trobol; but trobol dey always follow wiked pipol.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.