5 Pesin wey dey good dey always do good tins, but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu.
Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.
Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem.
Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
Wikedness nor dey pay pesin, but nor-tin dey shake good pipol.
Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.
Na trobol dey distroy wiked pipol, but doz wey dey fear God, go get life afta dem don die.
If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.
Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.
Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.
Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
Raitious pipol dey live korrect and good life and dia ways dey-dey strait.
Israel pipol sturbones dey tok against dem. Dia sin dey make dem kick stone fall and Judah pipol dey fall with dem too.
Israel sojas kon bigin attack dem. Naw, Benjamin sojas kon dey fear, bikos dem know sey, dem don die finish.