3 Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.
Pesin wey dey good dey always do good tins, but if yu dey do wiked tins, na yor own sin go distroy yu.
Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.
Wen pesin distroy ensef with di stupid tins wey e do, e go kon blame God.
But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.
Na di wahala wey wiked pipol kause dey distroy dem, bikos dem nor gri do wetin dey good.
God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans.
Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.
Make yu nor dey too wiked or bihave like fool, if not, yu fit die before yor time!
But E go kill anybody wey dey sin and fight against am. E go kill anybody wey nor respet am.
Dem kill di five kings for Midian wey bi Evi, Rekem, Zur, Hur and Reba. Dem still kill Balaam wey Beor born.
Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.