25 Make yu dey give and yu go prosper; help odas and yu go get help.
Dem bring basin, pots and bed shit kom gi-am. Dem still bring food: wheat, barley, grain wey dem roast, beans, peas, honey, cheese, cream and some sheep kom give David and en men.
Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.
To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack, but if yu nor dey sorry for poor pipol, dem go curse yu.
If yu do so, korn go full yor store and yu go get plenty wine to keep.
Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.
But good pesin dey plan to do good tins and na-im karata dey save am.
God go bless una wey dey sorry for pipol, una go receive mesi.