Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 11:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Wetin good pipol wont, dey bring good result; but evribody dey vex if wiked pesin get wetin e wont.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 11:23
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.


I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.


If to sey I fit live my life just as Yu tok


Na only one tin I ask from God and dat na wetin I wont! Na make I stay for God house forever, so dat I go dey si en mighty works kon always dey happy for inside en temple.


Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.


Di hope wey good pipol get, dey give dem joy, but wiked pipol, nor get wetin dem dey hope for.


Wen pipol give out dia money, dem dey get more; but doz wey nor dey give, nor dey get at-all.


Wen wiked pipol die, dia hope dey die with dem, bikos dem bilive on dia own pawa.


Good pipol dey always tink good, but make yu nor ever trust anytin wey wiked pipol tell yu.


Wise word go put betta food for yor tabol, but na only wahala wiked pipol go chop.


I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.


But my Oga, na Yu choose mi to serve yor pipol and dat na wetin I dey do. Yu know evritin wey I tok and I neva for wons ask Yu make Yu finish with dem.


God go bless una wey dey like to do good tins, E go give una evritin wey una wont.


But wetin wi go dey fear for na di Judgement Day wey dey kom and hell-fire wey go distroy doz wey bi God enemies.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ