20 God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.
I know sey Yu dey test evribody heart and Yu dey like doz wey dey respet diasef. I put my body for groun kon use all my heart take give Yu all dis tins and I don si how all yor pipol dey happy as dem dey give Yu dia gifts.
I nor go follow bad pesin make friend; I nor go tink of evil at-all.
God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.
Make una si as God dey bless pipol wey dey do wetin dey rite and obey en kommand.
True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.
But even before dem born mi, Yu don plan betta tins for mi kon dey tish mi wisdom.
Make yu know sey God go ponish wiked pipol; but na betta judgement go follow raitious pipol.
God hate pipol wey dey lie, but E like doz wey dey tok trut.
Na God dey guide innocent pipol, but na sin dey kontrol wiked pipol.
Foolish pipol dey laf dia own foolishness, but doz wey dey fear God, dey know and ask for forgivenes.
God hate evil plans, but E like betta words.
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
Doz wey good nor dey travel pass bad road; so look where yu dey go, bikos e fit save or distroy yor life.
Good pipol dey-dey sure of demsef; but wiked pipol sabi pritend well-well.
bikos God hate pipol wey dey do evil, but E dey draw raitious pipol near body.
Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.
If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words.
If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am.