18 Wiked pipol nor get gain for anytin, but reward dey for who dey do di korrect tin.
So God favor di nurse dem and Israel pipol kon dey plenty and strong.
But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem.
Na life bi di reward to do good, but sin dey put pesin for more trobol.
Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.
Na wikedness full di pipol heart, so dem must sofa for dia sin. God go distroy dia altar kon skata all dia holy pilas.
God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.
Koncerning di kind life wey una dey live before, wi sey make una trowey dat bad spirit wey dey make una do bad-bad tins
Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.