14 Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall, but wen doz wey dey give yu good advise many, yu go prosper.
If yu won save yor life and Solomon own, I go advise yu sey,
E do bad-bad tins for God eye just like Ahab, bikos wen en papa die, di pipol wey dey gi-am advise kon make am sin well-well.
Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
Wisdom bi like wota wey dey give life to wise pipol, but na waste of time to go tish foolish pesin.
Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.
So make sure sey yu plan well before yu go fight and di more dem advise yu well, di more yu go dey win.