13 Pesin wey dey judge anoda pesin, nor go fit keep sekret, but yu fit trust pesin wey dey tok trut.
Too mush tok dey make pesin sin, but wise pesin nor dey tok anyhow.
E too tok bad about odas, but if yu get sense, yu go fit kontrol yor mout.
Wise pipol nor dey karry body up, but foolish pipol dey show dia foolishness.
Good witness nor dey lie, but na lie-lie, wiked pipol dey tok.
If yu get sense, yu go fit kontrol yor tempa. E dey good make yu nor ansa if pesin offend yu.
Pesin wey dey do aproko nor go fit keep sekret. So make yu run from pesin wey dey tok too mush.
If yu and yor neighbour dey argue about sometin, e go good make una setol am between unasef and make yu nor tok about una sekret for publik.
So all di ofisas kom kweshon mi and I tell dem wetin di king sey make I tok. Nor-tin dem fit do, bikos anoda pesin nor hear wetin wi tok.
Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.
For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.
Di men kon tell am, “Wi swear with awa life sey, nor-tin go happen to yu! If yu nor tell anybody wetin wi kon do for here and God give us dis town, wi go sorry for yu and evritin wey bi yor own.”
But if yu tok wetin wi kom do for here, di swear wey wi swear, don skata bi dat.”