1 God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.
Make una nor dey play wayo wen una dey measure and sell tins give pipol, bikos God nor like am.
God hate pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
God nor like pipol wey dey weigh and measure tins with wayo.
But Israel pipol nor dey tok true; dem bi like Kanaan pipol wey dey shit and play dia customers wayo.
Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”