9 Pipol wey dey tok trut dey save and sikure, but wayo pipol dey waka enter trobol.
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
But God nor go ever help wiked pipol kon let pesin wey dey fear am, sofa.
Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
Make doz wey dey tink and tok bad-bad tins nor espect any good tin escept trobol.
E fit hide en wikedness, but evribody go soon si di bad tins wey e dey do.
Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am, but honest pesin dey get heart like lion.
Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.
Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall.
“Make una nor fear man, bikos nor-tin wey hide wey nor go kom out and know sekret wey pipol nor go know.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
Like dis too, pipol dey si di good work wey odas dey do and one day, di good work wey dem do for sekret, go kom out for publik.